jumia.com.ng

Monday 26 May 2014

Shakara oloje

Omo na so I dey waka pass Ojuelegba way I see as one bus come go jam one VW bug. As e happen I stand for one corner carry my pop corn come outside with 3D glasses because I know say na better action film I wan watch so. continue make you see as the thing go............




The owner of the bug now don come comot him motor dey shout for the bus driver say whether him dey mad and if he nor see am for there. The bus driver sef change am back for the owner of motor say if him nor get sense say why he go drive that kind thing. Owner of motor now con vex say mehn, he must kill that bus driver today. Normal Lagos style people don come gather start to dey beg the guy say make him no vex but the guy now nor gree him still dey charge say mehn that bus driver must bleed. The way Fela sing am for that him song “shakara” na so e dey happen live for my eyes, the guy say make them wait make he comot him dress say na die today. we think say na play until the guy comot him shirt, comot singlet we think say e don finish but na lie o! the guy comot trouser leave only pant. Next thing he open him boot comot wheel spanner say he don ready kill that bus driver. People now con dey fear for the bus driver begin dey beg the guy more because with all this activity the guy nor go go if he no see blood. Lo and behold after all the “shakara” the twat carry him very ugly body enter him motor without even slapping the bus driver. I wish say police arrest am for the "nonsensical higihaga" way him dey. I nor need point am out for you because Isure say you don see am for the photo. YEYE GUY!!!!!!!!!!!! But really its only in Lagos you can see such sha







8 comments:

  1. Lmaoo.......nice one

    ReplyDelete
  2. LOOL! Lagos n Buga! 'Shakara Oloje'! Nice one!

    ReplyDelete
  3. Hahaha gidi norma levo. But come o oga narrator na wa u o! U jus de form pakajin we... "popcorn for corner" u lieee!!! Tok tru say u holo ur bolee n granut for koro... u sabi chop pop corn? Lool just mocking about. Proper funny read... bare jokes. keep up the good work peoples!

    ReplyDelete
  4. Hahahaha......You my friend has impressed me. This one is another one in the bag.3 more of this and your "Otunbaship" will be renewed. Am really proud of you bro. But you should have tried getting more pictures of the guy now. And e pain me say nobody slap him face!!!#Rubbish

    ReplyDelete
  5. "you my friend has impressed me" come iyamu no start your blog with people wey de gbagaun anyhow oo ... i go tell fashola

    ReplyDelete
  6. Lmaooo........@anonymous 20:34
    Nice work Kareem

    ReplyDelete
  7. Well written..."nonsensical higihaga"?? Lool!

    N.

    ReplyDelete
  8. Nice one....dis na normal lagos style, na shakara and packaging everybody dey use rough am for lag....

    ReplyDelete