jumia.com.ng

Thursday 29 May 2014

Peep toe or?????

When i first looked at this shoe I thought it was a regular peep toe shoe but after looking closely I realized that those holes were self-made. Me feel say the shoe tear but some people feel say na style. What do you think??? leave your comment



Tuesday 27 May 2014

See Gobe

As I dey waka go house this evening, na so I one keke guy dey try over take one sweet red Hummer H3 from the left side(wrong side) na so he go scratch the motor. The hummer now, na woman dey drive am and una know as woman matter dey be na.....hehehe.. na so she use her motor pin that keke guy for corner say mehn you nor dey move anywhere. as she come down to look the damage na so argumenting start o. the keke guy start to dey beg beg up and down and as normal Lagos way the spectators start to beg too but the woman nor answer that one(normal woman way). she scoop the keke guy and him keke go house say them gats carry the matter go meet her "oga at the top"
p.s. I get pictures for una but them nor too make sense because I nor been wan make them lynch me cuz as i dey snap these ones them don dey look me funny



                              

Power holding or Bread holding???

Ever wondered why you don't have light?? #stolenpicture

Wet Morning

It is a wet morning in Lagos so be careful and drive safely so you nor go end up like this guy way go climb divider. Have a good day and be sure to look out for interesting stuff around you and send to us. This is as seen by our reader Adeola.

Monday 26 May 2014

Shakara oloje

Omo na so I dey waka pass Ojuelegba way I see as one bus come go jam one VW bug. As e happen I stand for one corner carry my pop corn come outside with 3D glasses because I know say na better action film I wan watch so. continue make you see as the thing go............


Sunday 25 May 2014

Picture mode activated

this one na from one of my guys for Abuja but na still our reader sef, Sylvester Odeh and his caption was "see what grown men are doing in my hood.....I weep for my generation"

 

Bookshop of life?????


I call it bookshop of life.........what do you call it? na one of our readers, Mrs Olamide Odeneye see am way she snap am send am to us make we laugh small.
 

                         

Turned up and turned out

Lagos been dey hot yesterday with the champions league final and plenty make sense weddings around. I nor go lie me sef turn up and had too much to drink but i made it back home with small drama sha. Sadly this guy nor turn up for house. SHIT!!!!


Friday 23 May 2014

Gbala na new dance way dey rain

Omo as one of my guys dey pass through one hood for Lagos, he see one dance way don dey rain for that side. The name na Gbala. me sef don try am the dance dey sweet. See a video after the cut..............

DON'T DIE IN SILENT........HAHAHAHA

So on my way to work this morning I saw this sticker in the bus to Ikeja. That dont die in silent part just killed me. hahahaha...............

Thursday 22 May 2014

Nor be only cat person go dey fear now............bird don join

I’m sure you guys heard about the incident yesterday in Ajegunle when a bird fell from the sky and turned into an old woman, well if you haven’t here’s your chance…
It started early in the morning around 7up area in Ajegunle, there was a lot of noise and normal Lagos way everybody don gather to see wetin dey happen outside. See more pictures and videos below............



Welcome to LagosOcrazy

Hello guys!!! Good Day, Wetin dey happen? You just might be wondering what do we need one more blog for in Nigeria? Don't bother thinking too hard, I'm going to explain it. We all understand the craziness of Lagos right? It’s hard not to really, since we virtually dwell in it, always stressful but then we just cannot deny that we LOVE LOVE LOVE the city and all its perks