jumia.com.ng

Tuesday 27 May 2014

See Gobe

As I dey waka go house this evening, na so I one keke guy dey try over take one sweet red Hummer H3 from the left side(wrong side) na so he go scratch the motor. The hummer now, na woman dey drive am and una know as woman matter dey be na.....hehehe.. na so she use her motor pin that keke guy for corner say mehn you nor dey move anywhere. as she come down to look the damage na so argumenting start o. the keke guy start to dey beg beg up and down and as normal Lagos way the spectators start to beg too but the woman nor answer that one(normal woman way). she scoop the keke guy and him keke go house say them gats carry the matter go meet her "oga at the top"
p.s. I get pictures for una but them nor too make sense because I nor been wan make them lynch me cuz as i dey snap these ones them don dey look me funny



                              

4 comments:

  1. I hate those keke guys mehn

    ReplyDelete
  2. Those keke peeps sabi form F1 for road naa... Normal level..

    ReplyDelete
  3. Hmmmmm na wa

    ReplyDelete
  4. Loooooool........Women in Lagos are feminist when it comes to driving and overtaking. Too wicked. Dem dey always carry the matter put for head like Gele!!!!

    ReplyDelete