We nor be political activist or gossips for here, we just dey share interesting things we dey happen for Lagos but if you still see wetin funny for your own side we fit still read am make we laugh
Thursday, 29 May 2014
Peep toe or?????
When i first looked at this shoe I thought it was a regular peep toe shoe but after looking closely I realized that those holes were self-made. Me feel say the shoe tear but some people feel say na style. What do you think??? leave your comment
Tuesday, 27 May 2014
See Gobe
As I dey waka go house this evening, na so I one keke guy dey try over take one sweet red Hummer H3 from the left side(wrong side) na so he go scratch the motor. The hummer now, na woman dey drive am and una know as woman matter dey be na.....hehehe.. na so she use her motor pin that keke guy for corner say mehn you nor dey move anywhere. as she come down to look the damage na so argumenting start o. the keke guy start to dey beg beg up and down and as normal Lagos way the spectators start to beg too but the woman nor answer that one(normal woman way). she scoop the keke guy and him keke go house say them gats carry the matter go meet her "oga at the top"
p.s. I get pictures for una but them nor too make sense because I nor been wan make them lynch me cuz as i dey snap these ones them don dey look me funny
p.s. I get pictures for una but them nor too make sense because I nor been wan make them lynch me cuz as i dey snap these ones them don dey look me funny
Wet Morning
It is a wet morning in Lagos so be careful and drive safely so you nor go end up like this guy way go climb divider. Have a good day and be sure to look out for interesting stuff around you and send to us. This is as seen by our reader Adeola.
Monday, 26 May 2014
Shakara oloje
Omo na so I dey waka pass Ojuelegba way I see as one bus
come go jam one VW bug. As e happen I stand for one corner carry my pop corn
come outside with 3D glasses because I know say na better action film I wan
watch so. continue make you see as the thing go............
Sunday, 25 May 2014
Picture mode activated
this one na from one of my guys for Abuja but na still our reader sef, Sylvester Odeh and his caption was "see what grown men are doing in my hood.....I weep for my generation"
Bookshop of life?????
Turned up and turned out
Lagos been dey hot yesterday with the champions league final and plenty make sense weddings around. I nor go lie me sef turn up and had too much to drink but i made it back home with small drama sha. Sadly this guy nor turn up for house. SHIT!!!!
Friday, 23 May 2014
Gbala na new dance way dey rain
Omo as one of my guys dey pass through one hood for Lagos, he see one dance way don dey rain for that side. The name na Gbala. me sef don try am the dance dey sweet. See a video after the cut..............
DON'T DIE IN SILENT........HAHAHAHA
So on my way to work this morning I saw this sticker in the bus to Ikeja. That dont die in silent part just killed me. hahahaha...............
Thursday, 22 May 2014
Nor be only cat person go dey fear now............bird don join
I’m sure you guys heard about the incident yesterday in
Ajegunle when a bird fell from the sky and turned into an old woman, well if
you haven’t here’s your chance…
It started early in the morning around 7up area in Ajegunle,
there was a lot of noise and normal Lagos way everybody don gather to see wetin
dey happen outside. See more pictures and videos below............
Welcome to LagosOcrazy
Hello guys!!! Good Day, Wetin
dey happen? You just might be wondering what do we need one more blog
for in Nigeria? Don't bother thinking too hard, I'm going to explain
it. We all understand the craziness of Lagos right? It’s hard not to
really, since we virtually dwell in it, always stressful but then we
just cannot deny that we LOVE LOVE LOVE the city and all its perks.
Subscribe to:
Posts (Atom)